I gave my dad the car E-Money gifted me, but he demanded I buy him a house for the car to stay or take it back, even my mom was JEalous about it.
When I dey school dey hungry my daddy go collect salary e go leave me go meet woman - Tiktokker Peller, Reveals to the public his personal story
Make I gist Una small about my daddy Because if him later come online, me I no sabi am.
That car wey E-Money give me, I give my daddy, my mummy even dey jEalous say that car big pass her own car.
But my daddy come say e dey park the car for filling station.
And him get house o. E come dey thrEAten me say make I buy house wey the car go dey stay.
Say him dey park the car for filling station. Say make I come carry the car if I no go buy the house.
Na him I tell them say make them go carry that car for me. E no come drop am. Month don end I suppose send am money but I no go send am.
When I dey school dey hungry my daddy go collect salary e go leave me go meet woman...


