HE KNEW THE CAR WAS BAD THAT WAS WHY HE DASHED ME…
PORTABLE blasts more than 5 people in just a single interview, and you say he is okay.
• “After I release my song ‘Brotherhood’ for BOBRISKY, I come fly go America dey find foreign artists, I dey my jejely… dey find my future oo… then I wan see DAVIDO call and him no future me oo instead him give me food then come dey video me…
Na WIZKID first throway dollar for my head”.
PORTABLE blasts DAVIDO for giving him only food, shoe, and money.
• “Then as I come dey with DAVIDO dey try ask’am to drop verse for me, Gbam… I wan see dev!l call DAVIDO dey tell’am say make him no help me because I be greedy person after him see video of me and DAVIDO together”.
PORTABLE blasts ZLATAN.
• “As I come back to Naija, this werey content creator CARTER SUFE abi na how them dey call’am… Call me say him want release song with me, na him I tell’am sey make him go find different person… sey I no be content creator and besides him no be my level”.
PORTABLE blasts CARTER EFE.
• “The one wey pain me pass be sey normally I been get plans to buy motor so after I come release my song ‘Brotherhood’ for BOBRISKY, na him Baba call me come tell me sey him wan dash me motor because I dey f!ght for brotherhood… baba dash me Benz I come find 5 mechanic for that Benz”.
PORTABLE blasts billionaire businessman OCHACHO that he dashed him a spoiled car.
PORTABLE is someone that is not ready to help anyone, but ready to collect from everyone.


