Social media personality Geh Geh claims he was deliberately denied food at Peller's wedding despite being invited, demanding either his meal be delivered or his asoebi money refunded.
"Another history has been made. Nobody in the history of Delta State attended Peller's wedding. Na me be the first man.
Peller na very he@rtl£ss human being. Na very w!ck£d person. This boy personally gave instruction to the caterer say make them no give me food.
The first time wey I reach there, dem first pretend. Dem ask me, “Geh Geh, wetin you go chop?” Dem even give me menu. I say, ‘Okay, give me rice and turkey.’
I go back go dey dance because I believe say food dey come. I danced for straight 30 minutes non-stop, yet dem no bring anything. Meanwhile, dem don serve everybody wey dey around me.
Make una show me one video wey I take eat for that Peller wedding. You invited me to that place just to humi!iat£ me. I just comot for the party.
Peller, you either waybill my rice give me or return my asoebi money. I no st&p!d.
Return my asoebi money now..."


